Proverbs Chapter 19

Abeg share

E Beta Make You Be Poor Man Wey Get Clean-hand

  1. E beta make pesin be poor man wit
    clean-hand, dan make pesin be lie-lie and
    mugu.
  2. E no good make pesin be olodo, and pesin
    wey dey rush—go commit error.
  3. Na di mumu way of man, dey make hin
    road get k-leg, and he go still dey para for
    Baba-God.
  4. Wealth dey bring plenty padi, but poor
    man padi go fashi am.
  5. Baba-God must punish lie-lie witness, and
    any-pesin wey dey always tok lie no go go
    free.
  6. Plenty pipo dey fyne favour from bigman,
    and everi- pesin na padi of man wey sabi give
    gift.
  7. Poor man brodas hate am—tokless of hin
    padi wey go run from am! Even though he
    dey beg to see dem, dem no go gree see am.
  8. Any-pesin wey get wisdom love hin own
    soul; and pesin wey like understanding go
    see alubarika (blessings).
  9. Baba-God must punish lie-lie witness, and
    any-pesin wey dey tok lie go kpeme.
  10. Expensive life no-fit mugu—tokless of
    make slave dey rule princes!
  11. Man wisdom go make am no dey
    quick vex; na levels for man to bone pesin
    wey offend am.
  12. Wen king para, e be like wen lion dey
    halla, but king favour be like showers on top
    of grass.
  13. Mumu pikin go fall hin papa hand, and
    wife wey like wahala—be like wen rain no
    wan gree stop.
  14. Na from papa and mama dem take dey
    collect properties and wealth, but na Baba-
    God dey give pesin—wife wey get-sense.
    15 Laziness dey make pesin sleep deep, and
    man wey no wan hustle go hungry die.
  15. Pesin wey dey keep di commandment
    dey guard hin life, but pesin wey no dey
    reason hin way go kpeme.
  16. Pesin wey kind to poor pipo, don borrow
    Baba-God moni, and Baba-God go pay am
    for wetin he don do.
  17. Correct your pikin wen hope still dey; no
    put your mind on wetin go spoil am.
  18. Man wey dey vex seriously must pay for wetin he don do; if you save am once, you go still need to sorry-for am again.
  19. Dey hear advice, accept wetin dem dey
    teach you, and las- las you go wise.
  20. Man get plenty plans for hin heart, but na
    Baba-God plan for hin life nahin go stand.
  21. Wetin man want na love. E beta make
    you poor, dan make you be lie-lie.
  22. Di fear of Baba-God dey lead to life, and
    pesin wey get am go belleful forever, and
    wahala no go fit reach where he dey stay.
  23. Lazy man put hin hand for inside plate;
    and he no-fit carry hin hand put back for hin
    mouth!
  24. Flog mugu and pipo go get-sense.
    Correct man wey get understanding, and he
    go sabi sometin.
  25. Pikin wey do hin papa anyhow, con
    pursue hin mama komot, na pikin wey dey
    bring shame plus disgrace.
  26. My pikin, if you stop to dey listen to
    wetin dem dey teach you, you go waka
    komot from words of knowledge.
  27. Corrupt witness dey use justice play, and
    wicked pesin mouth dey chop evil.
  28. Punishment dey wait for mumu pipo, and
    beating must touch swegbe back.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *