Proverbs Chapter 20
Shayo Na Bastard
- Shayo na bastard, and ogogoro dey cos
fight, any-pesin wey let dem make am waka
miss-road na mumu. - Wen king para—e be like wen lion dey
halla; any-pesin wey make am vex dey play
wit hin life. - Na respect for man to stop fight—since
any mugu fit start kwanta. - Lazy man no dey hustle for hin farm for di
right season; so he go beg for harvest time,
and he no go see shi-shi. - Di plan for man heart be like deep water,
but man wey get understanding dey fetch am
come out. - Most men dey tok beta tins about demsef,
but who fit fyne faithful man? - Good man dey live clean life; hin pikin na
blessings afta am. - King wey sidon for king-chair to judge
dey scata everi evil wit hin eyes. - Who fit tok sey, “I don keep my heart
clean; and I dey pure from sin”? - Weight wey no balance , and
measurement wey no correct—both of dem be like tufiakwa for Baba-God. - Evensef, dem know small pikin wit how
dem dey behave, whether hin behaviour dey
pure or right. - Ears wey dey hear and eyes wey dey
see—Baba-God nahin do di two of dem. - No love sleep, or you go poor las-las;
wake up and you go get food burku. - “E no good, e no good!” Naso customer
dey yarn, las-las dem go komot go dey make-
mouth wit wetin dem don buy. - Gold and rubies burku, but lips wey dey
tok knowledge na beta-tin. - Collect di cloth of pesin wey do
guarantor for jjc; collect am as collateral, if
he do am for strange woman. - Food wey man collect wit ojoro dey
sweet for hin mouth, but las-las he go chop
stone. - Plan dey stand wit good advice; na wit
beta advice dem take dey fight war. - Tatafo dey cast secret; so no rub-mind
wit pesin wey get sweet-mouth. - If pesin curse hin papa or mama, hin lamp
go off for inside full darkness. - Inheritance wey pesin first-first rush
collect—no go bring blessing las-las. - No tok sey, “I go do you back for di
wrong tin wey you do!” Wait for Baba-God
and he go save you. - Weight wey no balance na tufiakwa for
Baba-God, and ojoro measurement no good. - Na Baba-God dey direct pesin waka.
How you con fit understand your own way? - Na trap for pesin to rush make promise to
Baba-God, con dey reason di promise later. - Wise king dey blow wicked pipo
komot like chaff [from among good pipo],
and go march dem wit tyres [to separate di
chaff from di seeds]. - Man spirit na Baba-God lamp; e dey
torchlight inside di deep path of hin heart. - Mercy plus truth nahin dey keep king
safe, and na wit soft- love he take dey keep
hin king-chair. - Na strength be young men levels, and
white hair nahin make senior-men fine. - Blow wey dey pain—dey clean evil, as
flogging dey clean deep inside pesin heart.