Proverbs Chapter 21
Di King Heart Dey For Baba-God Hand
- King heart dey for Baba-God hand, he dey direct am go where he like—like river of water.
- All man ways dey right to am for hin heart,
but Baba-God nahin dey judge pesin mind. - Baba-God prefer make pesin do wetin dey
right and justice, dan make pesin give am
sacrifice. - Big-eyes, and buga for heart—evil man
movement na sin. - Di plan of pesin wey serious for business
go surely bring yanfu-yanfu, but di plan of
rush-rush pipo—go surely lead to poverty. - Moni wey pesin make wit wuru-wuru
tongue—na dream wey no dey last for pipo
wey dey fyne death. - Di blood shed of evil pipo go make dem
kpeme, becos dem no gree do wetin dey
right. - Di way of corrupt man na wuru-wuru, but
as for man wey pure—hin way dey right. - E beta make pesin stay for one corner on
top of roof, dan make pesin dey for house wit
woman wey like to quarrel. - Wicked man dey fyne where to do evil;
hin neighbour no- fit see favour for hin eyes. - Wen dem punish mugu—ordinary pipo
go learn wisdom, but wen dem teach wise
man, he dey sabi more. - Baba-God wey good—dey use wisdom
reason wicked man house, and he go
overthrow wicked pipo for dia wickedness. - If pesin cover hin ears wen poor man dey
cry, hinsef go cry and no-pesin go ansa am. - Gift wey dem give pesin codedly dey
make pesin wey dey vex—pam, and egunje
wey dem give codedly—dey make pesin
wey dey vex—calm down. - Good pipo dey happy wen justice
happun, but all di pipo wey dey do evil tins
go scata. - Na deadbody go be di padi of man wey
don komot from di road of understanding. - Pesin wey like faji go be poor man, any-
pesin wey like wine and sweet tins no go fit
make kudi [moni, ego]. - Dem go use wicked pipo life take bail
good pipo, and dem go use unfaithful pipo
life take exchange for pipo wey get clean-
heart. - E beta make you stay for desert, dan
make you stay wit woman wey like to dey
para, and wey like quarrel. - Fine-fine-tins, and ororo brekete for wise
man house, but mumu man dey waste everitin wey he get. - Pesin wey dey follow goodness plus
mercy go get life, goodness, plus levels. - Wise man go climb di wall of city of
strong men [attack dia city], con fall dia
strong-house wey dem trust. - Pesin wey guard hin mouth and hin
tongue—go keep hin soul from kasala. - Man wey dey make-
mouth and man wey dey carry shoulder
up—“Mumu” nahin name; he dey feel-big,
and he dey buga. - Lazy man wish nahin go kill am, becos he
no gree use hin hand hustle. - Hin eyes dey shuuk wit longatrot from
morning till night, but good man dey give wit
open heart. - Wicked man sacrifice na
tufiakwa—tokless of wen he give di
sacrifice wit bad mind! - Lie-lie witness go kpeme, but pesin wey
dey listen—go tok well. - Wicked man dey bone- face, but as for
man wey get clean- heart—he dey stand
gidigbam for hin business. - No wisdom, no understanding, and no
idea—wey fit stand against Baba-God. - Dem don arrange horse for di day of war,
but na Baba-God dey save pesin.
Questions about Proverbs 21
What is Proverbs 21 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 21 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-21/
Where can I read Proverbs 21 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 21 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-21/
Which Bible book contains Proverbs 21?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 21?
The chapter identified by this reference is 21.
Topics connected to this passage
- Faith
- Salvation
- Forgiveness
- Wisdom
- Money
- Guidance