Proverbs Chapter 25

Abeg share

More Proverbs Of Solomon

  1. Dis one sef na more proverbs of King
    Solomon, wey Hezekiah, king of
    Judea—men write down.
  2. Na levels for Baba-God to code mata; and
    na levels for king to understand mata.
  3. As heaven high reach, and as earth deep
    reach, naso dem no-fit reason wetin dey for
    inside oba heart.
  4. Komot di waste material from silver, and
    di silversmith go fit produce jewelry.
  5. Komot wicked pipo from king side, and
    hin king-chair go stand gidigbam wit
    goodness.
  6. No make-mouth for king front, and no go
    claim sey you be great man;
  7. e beta make he tell you sey, “Come up
    here,” dan make he fall your hand for front of
    di princes. Wetin you don see wit your eyes,
  8. no carry am rush go court, wetin you go do
    if your neighbour con make shame catch you
    las-las?
  9. If you dey argue mata wit your neighbour,
    no open anoda pesin secret,
  10. or if any-pesin hear am, shame go catch
    you and your name go spoil.
  11. Word wey pesin tok for di right time—be
    like golden apple for silver basket.
  12. To use wisdom criticize pesin wey dey
    hear word—be like gold earring or fine
    jewelries.
  13. Messenger wey dem trust—be like di
    cold snow for harvest time—to di pipo wey
    send am; he dey ginger di spirit of hin oga.
  14. Like cloud and heavy- breeze wey no
    gree bring rain, naso man wey dey make-
    mouth wit gift wey he no-fit give—be.
  15. Na wit serious patience you go fit beg king, and soft tongue fit break bone.
  16. If you see honey, chop di one wey you fit
    chop—if you chop too much, you go start to
    dey vomit.
  17. No dey too go your neighbour house—or
    dem go taya for you, con start to dey hate
    you.
  18. To lie for your neighbour head, be like
    sey make you nack am wit kpako, or shuuk
    am wit sword, or sharp arrow.
  19. To trust unfaithful pesin wen yawa gas,
    be like make your teeth dey pain you, and e
    be like make your leg shift from e joint.
  20. Like pesin wey komot hin cloth for cold
    weather, or like pouring ogogoro on top
    wound—naso e be to sing for pesin wey no
    get joy.
  21. If your enemies dey hungry, give dem
    food to chop; if he wan drink water, give am
    water drink.
  22. If you do like dat, you don put hot
    charcoal for hin head, and Baba-God go pay
    you.
  23. As north breeze take dey carry rain come,
    naso pesin wey get amebor tongue—dey
    make face spoil.
  24. E beta make you dey stay for one corner
    of roof, dan make you dey stay for di same
    house wit woman wey like quarrel.
  25. As cold water be for soul wey don taya,
    naso good news be—from abroad.
  26. Good man wey give wicked man
    chance—be like water wey full wit portor-
    portor, and well wit bad water.
  27. E no good to chop too much honey, and
    naso e be sef wen pesin dey fyne praise from
    pipo—no be levels be dat.
  28. Man wey no-fit control hinsef, be like
    city wey e wall don kpafuka.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *