Proverbs Chapter 24
No Dey Jealous Evil Men
- No envy wicked men, no wish to stay wit
dem. - Dem dey plan to shed blood for dia heart,
and dia lips dey tok as dem wan take cos
wahala. - Na wit wisdom pipo take dey build house,
and na wit understanding—house take dey
stand gidigbam. - Wit knowledge, di rooms go full wit everi
fine-fine- tins, plus good tins. - Wise man strong kakaraka, eehn..man
wey like to learn go get more-more pawa. - You need guidance to plan for war, and
plenty advisers dey bring safety. - Mumu head no-fit carry wisdom; he no get
anytin to tok for meeting. - Dem go know pesin wey dey plan evil as
badbelle pesin. - Yeye tinking na sin, and pesin wey no-get-
sense na tufiakwa for men. - If you fall on di day wen kasala burst,
your pawa neva reach be dat! - Save pesin wey dey waka go kpeme; hold
pesin wey dey stagger dey go where dem go
kill am. - If you tok sey, “But we no know anytin
about am.” Abi you tink sey Baba-God wey
dey judge pesin heart no dey reason?” Abi
Baba-God wey dey guard your soul—no
know wetin sup? Abi he no go pay everi-
pesin based-on wetin dem don do? - Chop honey, my pikin, becos honey
good, honey wey
sweet for your mouth. - Naso wisdom sef sweet for di soul if you
sabi am; if you fyne wisdom, you don get
bright future, and your hope no go cut
komot. - Oh wicked man, make you no attack
good man house, no rob hin house. - Good man fit fall seven times, he go rise
up again, but kasala dey bring wicked pipo
down. - No dey laff wen your enemy fall; no dey
happy wen your enemy stagger, - or Baba-God go see am, and he no go
happy—con turn hin vex komot from am. - No let evil men dey make your heart cut,
or jealous wicked pipo. - Evil man no get bright future, and wicked
pesin lamp go off. - My son, fear Baba-God and di king, and
no join pipo wey dey tok about change, and
wey wan rebel. - Dia palava go start sharply, and who
know di kain punishment wey both di king
and Baba-God fit carry come?
More Words Of Wise Man - Dis one sef na wise words; e no good
make pesin dey use partiality judge mata. - Any-pesin wey tell wicked pesin sey,
“You be good pesin,” pipo go curse am and
nations go hate am. - But e go beta for pipo wey condemn
wicked pipo, and dem go get beta blessings. - Correct ansa be like kiss for lips.
- Arrange your business for outside,
arrange your land, afta dat build your house. - No bad-mouth your neighbour for any
reason, abi you go use your lips do wayo? - No tok sey, “I go do am back wetin he do to me; I go pay dat man back for wetin he do me.”
- I waka pass lazy man farm, I waka pass di
grape-farm of pesin wey no-get-sense. - Shuku-shuku full everi-where, grass don
grow full all di ground, and di fence don
kpafuka. - Wen I see am, I reason wetin I
observe—con learn lesson from wetin I see. - Small sleep, small rest, and make pesin
fold hin hand relax small - and before you know, poverty go show
like tiff, and your bills go meet you like
armed robber.
Questions about Proverbs 24
What is Proverbs 24 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 24 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-24/
Where can I read Proverbs 24 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 24 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-24/
Which Bible book contains Proverbs 24?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 24?
The chapter identified by this reference is 24.
Topics connected to this passage
- Hope
- Salvation
- Forgiveness
- Peace
- Wisdom
- Fear
- Strength