Proverbs Chapter 4

Abeg share

Listen To Your Papa wisdom

  1. My son, hear wetin your papa dey teach
    you; put your ears for ground make you sabi
    understand.
  2. I dey teach you beta tin, so make you no
    fashi wetin I dey teach you.
  3. Wen I be boy for my papa house, wen I still
    small, and be di only pikin wey my mama
    get.
  4. My papa teach me, con tell me sey, “Hold
    my words for your heart; do wetin I tell you
    to do and you go live.
  5. Get wisdom, get understanding; no fashi
    my words or turn komot from di words from
    my mouth.
  6. No fashi wisdom and she go keep you;
    love her and she go protect you.
  7. Wisdom na di koko; so get wisdom. And
    inside everitin wey you get, make sure sey
    you get understanding.
  8. If you value wisdom, she go promote you;
    gum-body wit her and she go give you
    respect.
  9. She go use flower take make crown of
    grace for your head, con give you crown wey
    get levels.”
  10. Hear me my pikin, listen to di tins wey I
    dey tell you, and you go get long life.
  11. I don teach you for di way of wisdom, and
    I don carry you pass di correct ways.
  12. Notin go fit stop you wen you waka, and
    wen you run, you no go stagger.
  13. Hold my teachings tight, no let am go;
  14. guard am well-well, becos she be your life.
  15. No enta bad pipo way, or follow evil men
    waka.
  16. No reason am, no travel for dia way;
    komot from dia way, con waka go your own
    way.
  17. Dem no-fit sleep until dem do evil; dem
    no-fit rest until dem fall pesin.
    1 7 . D e m d e y c h o p d i f o o d o f
    wickedness—con dey drink ogogoro of
    blood.
  18. But di way of pesin wey get clean-heart
    be like sun wey dey shine, wey dey shine
    more-more enta di perfect day.
  19. But badbelle pipo way be like darkness;
    dem no know wetin dey make dem stagger.
  20. My pikin, turn your ears to wetin I dey
    tok, listen well-well to my words.
  21. No let dem komot for your eyes, keep
    dem inside-inside your heart;
  22. dem be life for those pipo wey see dem,
    plus good health for man full body.
  23. Guard your heart well- well, becos na
    from there all di mata of life dey flow from.
  24. Komot your mouth from wuru-wuru; and
    no let bend-bend yarnings komot from your
    lips.
  25. Make your eyes dey look straight go
    front, and your eyes dey face your destiny.
  26. Reason yoursef, and make all your ways
    stand gidigbam.
  27. No turn go right or left; waka komot from
    evil.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *