Proverbs Chapter 3
Trust Baba-God
- My son, no fashi wetin I dey teach you, but
keep di tins wey I tell you for your mind. - Dem go make you live long, dem go make
you see old age, and dem go give you alafia. - No ever fashi mercy and truth, tie dem join
your neck, write am for di book of your heart. - Naso you go take get favour and high level
for Baba-God eyes, plus men eyes. - Trust Baba-God wit all your heart, no
depend on your own understanding. - Ask Baba-God to guide all your way, and
he go make your way straight. - For your own eyes, no see yoursef as pesin wey too get- sense; fear Baba-God and komot hand from evil tins.
- E go make your body get good health, and
make your bones strong kakaraka. - Use everitin wey you get take honour
Baba-God, and wit di first-fruit of your
harvest. - Naso your store go full brekete, and your
containers go pour-throway wit fresh wine. - My pikin, no throway- face wen Baba-
God dey teach you lesson, and no dey vex
wen Baba-God dey correct you. - Becos Baba-God dey correct pesin wey
he love, just as papa take dey correct hin pikin
wey he like well-well.
Blessings For Di Man Wey Don See
Wisdom - Man wey don fyne wisdom na happy
man, and man wey don gain understanding. - Wisdom go pay you pass silver, and she
go give you gain wey pass fine gold. - She fine pass rubies; inside everitin wey
you want for dis life-no one beta reach
wisdom. - Long life dey for her right hand, plenty
moni, plus respect dey for her left hand. - Her ways fine well- well, and na so-so
peace full all her way. - She be tree of life for those pipo wey hold
her tight, and di pipo wey keep her—na
happy pipo. - Na wisdom Baba-God use build di
foundation of di earth, and he use
understanding take set di heaven gidigbam. - Na wit hin knowledge he make di rivers
flow, and di clouds to pour rain for di earth. - My son, no let beta wisdom and common
sense komot from your eyes, hold dem tight, - dem go be life to your soul, and dem go be
like fine necklace for your neck, - Naso you go dey waka for your way wit
safety, and your leg no go nack sometin wey
go make you stagger; - You no go fear—any time wen you lie
down for bed. Your sleep go sweet well-well
wen you lie down for bed. - No dey fear sey kasala go just burst, or
dey fear wahala from badbelle pipo wen e
show. - Na Baba-God go be your full-mind, and
he no go let anytin catch your leg. - No hide beta tin from those pipo wey
really need am-wen di pawa dey your hand to
epp. - No tell your neighbour sey, “Go, make
you come back, and I go give you
tomorrow,” wen di tin dey wit you. - No plan bad tin for your neighbour becos
he feel safe to stay near you. - No kwanta wit pesin for no reason—wen
di pesin no do anytin bad to you. - No jealous pipo wey dey oppress pipo, or
copy any of hin way. - Pesin wey hin way no straight na
tufiakwa to Baba-God, but hin secret
wisdom dey wit pipo wey get clean-heart. - Baba-God curse dey for wicked man
house, but Baba-God dey bless good pesin
house. - Baba-God dey laff pipo wey dey use
pesin laff, but hin grace dey wit pipo wey dey
do jeje. - Wise pipo go inherit respect, but na
shame go be di promotion for mumu pipo.
Questions about Proverbs 3
What is Proverbs 3 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 3 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-3/
Where can I read Proverbs 3 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 3 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-3/
Which Bible book contains Proverbs 3?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 3?
The chapter identified by this reference is 3.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Prayer
- Wisdom
- Fear
- Strength
- Healing
- Guidance