Proverbs Chapter 8
Wisdom Dey Call
- . Abi wisdom no dey halla?
Abi understanding no dey raise her voice? - She dey stand on top of di highest place,
for corner of road, and for junction. - For corner of di gate of di city, for
doormot, na for there she dey halla. - “I dey call una, nnaa men, I dey halla all of
una; I dey raise my voice to everi human
being, - You, ‘ordinary pipo,’ understand wisdom:
and you wey be swegbe, try to get heart wey
sabi understand. - Listen, I get beta tins to tok; I dey open my
lips dey tok
wetin dey right. - My mouth dey tok di truth, and
wickedness na tufiakwa for my lips. - All di words wey dey komot from my
mouth na wit goodness, no one of my words be korni-korni or bend-bend tok. - All my words dey clear to pipo wey
understand, pipo wey sabi know sey my
words na correct. - Choose wetin I dey teach you instead of
silver, choose knowledge instead of gold. - Wisdom beta pass rubies, and notin you
wish for dis life—wey you fit use compare
wisdom. - “Me, wisdom, dey always dey wit
akonuche (common sense), na me get
knowledge and common sense. - To fear Baba-God—na to hate evil tin; I
hate make pesin dey make-mouth, make
pesin dey carry shoulder up, evil behaviour,
plus mouth wey dey miss-yarn. - Na me get good advice, and beta wisdom.
Na me be understanding, and I get pawa. - Na tru me—kings take dey reign, and
rulers take dey make beta laws wit justice. - Na me princes dey use rule, plus leaders,
even all di judges of di earth. - I love those pipo wey love me, and
those pipo wey dey fyne me seriously—go
see me. - Riches plus respect dey wit me, plus
wealth wey dey last, and goodness. - Di tins wey you go gain from me beta
pass gold; eehn….e beta pass pure gold,
wetin you go gain from me—beta pass
silver. - I dey waka for di way of goodness, for di
road of justice, - I dey give pipo wey love me riches, con
make dia bank brekete wit beta-beta-tins. - Baba-God make me first of all, before he
even make anytin. - I don stand gidigbam from everlasting,
from di starting, before di world start. - Wen big-big-river neva dey, na dat time
dem born me, wen plenty water neva dey
flow from ground; - before di mountain settle for e place,
before di hills dey, na dat time Baba-God
born me. - Before he make di earth or di fields, or
any of di first dust of di world. - I dey for there wen he put di heaven for e
place, wen he draw di line wey di sky take
meet di big-big-river. - I dey for there wen he stand di cloud for
up-up, con give di water pawa to flow from
di big-big-river. - I dey for there wen he give di big-rivers dia boundary, so dat di water no go cross e lane, I dey for there wen e mark di
- foundations of di earth.
- Na me be di ogbonge artist wey dey for
hin side. Na me dey make body sweet Am
everi day—as I dey happy everi time for hin
front. - I dey happy for everitin wey Baba-God
make, and I dey happy for everi human
being. - “Now, my pikin, listen to me; pipo wey
dey follow my way get blesings - Listen to wetin I dey teach you, and get-
sense; make you no fashi am. - Blessings for di man wey dey listen to
me, wey dey watch for my door everi day,
and wey dey wait for my doormot. - Any-pesin wey see me don see life, and
he go receive favour from Baba-God. - But any-pesin wey no fyne me dey
wound hinsef, and everi-pesin wey hate me
love death.”