Proverbs Chapter 9
Di Way of Wisdom
- Wisdom don build her house, she don
form seven pillars. - She don prepare her food, con mix her
drink; she don set her table sef. - She don send her house- girls go out. She
dey halla from di place wey high pass for di
city, - “Make pipo wey no know anytin—come
here!” As for di man wey no get
understanding, she dey follow am tok! - “Bia, chop my food, and drink di wine wey
I mix. - Fashi mumu level—make you live; follow
di way of understanding. - “Any-pesin wey correct mugu go receive
insult; any-pesin wey correct wicked
man—dey wound hinsef. - No correct mugu—or he go hate you;
correct wise man and he go love you. - Tell wise man sometin wey make-sense
and he go wise more-more; teach righteous
man and he go add-join wetin he don already
know. - “Wisdom start wen you begin to fear
Baba-God, and to sabi di Holy One na
understanding. - Na wit me you go fit live long, and many
years go add-join to your life. - If you wise, your wisdom go pay you; if
you be swegbe na only you go use your head carry am.- Di Way of Mumu
- Woman wey be mumu dey make noise.
She no get-sense and she be olodo. - She dey sidon for di doormot of her
house, she go sidon for place wey high pass
for di city. - She dey call pipo wey dey waka pass,
wey dey mind dia own business, - . “ Make any- pesin wey no-
get- sense—turn face here”; and she dey
follow pipo wey no get understanding dey
tok, - “Water wey dem tiff dey sweet; food wey
dem hide chop dey enta body!” - But he no know sey na dead-body dey for
there, and her visitor dey go inside grave.