Psalm Chapter 110

Abeg share

Di King Wey Baba-God Choose

  1. Dis na Psalm of David. My Oga tell my Oga sey, “Sidon for my right hand—until I go turn your enemies to stool for your leg.”

2. Baba-God go stretch your pawaful kingdom from Zion, you go rule among your enemies.

3. Your sojas go ready to serve wen di day of fight reach, inside di holy beauty, from wen morning break: di strength of di youth belong to you.

4. Baba-God don swear and he no go change hin mind: “You be priest forever for di line of Melchizedek.”

5. Baba -God dey for your right hand—he go kill kings on di day wey he dey vex.

6. He go judge di nations, he go full everi where wit deadbody. He go kill di leaders of plenty kontris.

7. He go drink from di river wey dey corner of road, and he go raise hin head up.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *