Psalm Chapter 111

Abeg share

To Dey Praise Baba-God

  1. Praise Baba-God. I go worship Baba-God wit all my heart—for di meeting of holy-pipo, and for where hin pipo gada.

2. Baba-God handwork na ogbonge, pipo wey like dem dey learn dem.

3. Pipo dey respect hin works, dem get levels, and hin goodness dey last forever.

4. He don make pipo remember hin wonderful works. Baba-God brekete wit grace, and he get soft-heart.

5. He dey provide food for pipo wey dey fear am; he dey remember hin promise forever.

6. He don show hin pipo di pawa of hin works, wen he give dem di land of oda nations.

7. Di tins wey he dey do wit hin hand na wit faithfulness plus justice; pesin fit trust hin commandments.

8. Dem dey kamkpe for ever and ever, na truth and righteousness he take do am.

9. He dey save hin pipo, and he no go ever break hin agreement wit dem. Hin name Holy, and hin name na Ogbonge.

10. Di fear of Baba-God na where wisdom take start; everi-pesin wey dey keep hin commandment dey get beta understanding. Hin praise dey last forever!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now