Psalm Chapter 113
Baba-God Dey Carry humble Pipo Go Up
- Praise Baba-God. Cut-cap—oh servant of Baba-God, praise Baba-God name.
2. Make we praise Baba-God name, from now and forever.
3. From where di sun dey rise—reach where e dey go down, make dem praise Baba-God name.
4. Baba-God high pass all di nations, and hin levels high pass di heavens!
5.Who be like Baba-God awa Oga—wey sidon for king-chair wey high,
6. wey dey look down to see di heavens plus di earth?
7. He dey raise di poor from dust, con carry pesin wey need epp from yama-yama;
8. he make dem sidon wit princes, wit princes of hin pipo.
9. He settle woman wey no fit born pikin for her house—as mama wey dey happy wit
plenty pikin. Make una praise Baba-God.