Psalm Chapter 118
Tanks-giving
- Give tanks to Baba-God becos he dey good, and he dey sorry-for pesin forever.
2. Make Israel tok sey: “He dey sorry for pesin forever.”
3. Make di house of Aaron tok sey, “He dey sorry-for pesin forever.”
4. Make di pipo wey dey fear Baba-God tok sey, “He dey sorry-for pesin forever.”
5. I cry to Baba-God for inside my palava—and he ansa me, he free me—con put me for big space.
6. Baba-God dey wit me, I no go fear. Wetin men fit do me?
7. Baba-God dey wit me, nahin dey epp me; so I go see my wish upon babelle pipo.
8. E beta to trust Baba-God, dan to trust human being.
9. E beta to trust Baba-God, dan to trust pipo wey get pawa.
10. All di nations gada round me, but I scata dem wit Baba-God name.
11. Dem surround me for everi corner, but I scata dem wit Baba-God name.
12. Dem gada me round like bees, but dem quench like shuku-shuku wey dey burn; I go scata dem wit Baba-God name.
13. You push me hard—so dat I go fall, but Baba-God epp me.
14. Baba-God na my strength and my song; nahin be my salvation.
15. Songs of joy and salvation dey for di house of good pipo: Baba-God right hand don do strong tins.
16. Baba-God right hand dey for up-up; Baba-God right hand don do strong tins.
17. I no go kpeme, but I go live, and I go tok about Baba-God handwork.
18. Baba-God don discipline me wella, but he no gree let me kpeme.
19. Open di gate of goodness for me; I go enta con give praise to Baba-God.
20. Dis na di gate of Baba-God wey good pipo go pass enta.
21. I go give you tanks becos you ansa me; na you dy save me.
22. Di stone wey di builder fashi, don turn to di chief foundation stone,
23. Baba-God don do am, and e surprise awa eyes.
24. Dis na di day wey Baba-God don make; we go jolly con happy inside am.
25. Oh Baba-God, I pray, save us now. Oh Baba-God, prosper us.
26. Blessings for di pesin wey dey come wit Baba-God name. We don bless you from Baba-God house.
27. Baba-God na Oga, and he don give us light; tie di sacrifice wit ropes to di horn of di altar.
28. Na you be my God and I go praise you; you be my God and I go cut-cap for you.
29. Oh make una give tanks to Baba-God becos he dey good; and he dey sorry-for pesin forever.