Psalm Chapter 125
Baba-God Surround Hin Pipo
1.Dis na song of rising. Those pipo wey trust Baba-God be like di Mountain of Zion wey no-fit shake, but wey dey kamkpe forever.
2. As mountain take round Jerusalem, naso Baba-God take round hin pipo—both now and forever.
3. Di govment of wicked pipo no go dey for di land wey Baba-God don give good pipo, so dat good pipo no go use dia hand take do evil tins.
4. Baba-God, do good to those pipo wey dey good, to those pipo wey get clean-heart.
5. But pipo wey turn follow kurukere way, Baba-God go pursue dem komot wit pipo wey do evil tins. Make peace dey for Israel.