Psalm Chapter 129
Dis Na Prayer Against Israel Enemies
- Dis na song of rising. Dem don dey oppress me—no-be-small, since I be pikin—make Israel tok sey—
2. dem don dey oppress me no-be small, since I be small pikin, but my head too strong for dem.
3. Dem don dig my back as farmer take dey dig hole for ground to plant seed.
4. But Baba-God dey good, he don cut di ropes of wicked men to pieces.
5. Make shame catch all di pipo wey hate Zion, and make dem turn back.
6. Make dem be like grass for roof, wey dey dry even before e grow;
7. wey di farmer no-fit harvest, or wey dem no-fit tie for bundle.
8. Make those pipo wey dey waka pass no tell dem sey, “Make Baba-God blessings dey wit you; we bless you wit Baba-God name.”