Psalm Chapter 13

Abeg share
  1. How long Oh Baba-God wey you go fashi me forever? How long you go dey
    dodge your face from me?
  2. How long I go dey fight wit my mind and evey day wahala upon wahala full my
    heart? How long my enemies to win me?
  3. Look my side make you ansa, Oh Lord my God. Shine light for my eyes, or I go
    sleep inside death;
  4. my enemies go con tok sey, “I don win am,” and my enemies go jirate if I fall.
  5. But I trust your love wey no dey fail; my heart dey happy sey you save me.
  6. I go sing for Baba-God becos he dey so good to me.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *