Psalm Chapter 13
- How long Oh Baba-God wey you go fashi me forever? How long you go dey
dodge your face from me? - How long I go dey fight wit my mind and evey day wahala upon wahala full my
heart? How long my enemies to win me? - Look my side make you ansa, Oh Lord my God. Shine light for my eyes, or I go
sleep inside death; - my enemies go con tok sey, “I don win am,” and my enemies go jirate if I fall.
- But I trust your love wey no dey fail; my heart dey happy sey you save me.
- I go sing for Baba-God becos he dey so good to me.
Questions about Psalm 13
What is Psalm 13 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 13 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-13/
Where can I read Psalm 13 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 13 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-13/
Which Bible book contains Psalm 13?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 13?
The chapter identified by this reference is 13.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Salvation
- Worship