Psalm Chapter 132

Abeg share

Baba-God Worship-place

  1. Dis na song of rising. Oh Baba-God, no forget David wit all di suffer-head wey he don pass tru.

2. How he take swear to Baba-God, con make promise to di Great One of Jacob;

3. “Surely, I no go enta inside my house or sleep for my bed—

4. I no go close my eyes sleep, or let sleep catch my eyes,

5. until I fyne place for Baba-God, house for di Great One of Jacob.”

6. We hear am for Ephratah, we see am for inside forest.

7. “Make we go where he dey stay; make we worship for hin stool.

8. Oh Baba-God! Arise make you come where you dey rest put, along wit di ark of your pawa.

9. Make your priest baffup wit goodness; make your holy- pipo sing wit happiness.”

10. Make you no fashi di pesin wey you anoint, becos of your servant David.

11. Baba-God swear inside truth to David, promise wey he no go fashi, “I go make one of your pikin sidon for di king-chair—

12. If your pikin keep my agreement and di laws wey I teach dem, naso dia own pikin sef go sidon for di king-chair for ever and ever.”

13. Baba-God don choose Zion, he wish to make am as hin house:

14. “Dis na di place wey I go dey rest for ever and ever; na here I go dey, becos I want am like dat.

15. I go bless dis city wit plenty-plenty beta tins; I go give her poor pipo food wey go belleful dem.

16. I go baffup her priest wit salvation, and her holy-pipo go shout wit happiness.

17. “Na for here I go make David horn grow—and I go prepare light for di pesin wey I anoint.

18. I go wear shame for hin enemies body, but di crown wey dey hin head go dey shine.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *