Psalm Chapter 133

Abeg share

Brodas Wey Gum Body

  1. Dis na song of rising. Of David. See as everitin good, and as everitin segemenge—wen brodas dey stay togeda in unity.
  2. E be like beta ororo wey dem pour for pesin head—wey dey rush go down for hin bear-bear, wey dey rush go down for Aaron bear- bear, down to di neck of hin cloth.
  3. E be like wen di dew of Hermon, and like di dew wey dey fall on top di mountains of Zion. Na for there Baba-God promise hin blessings, even life wey dey last forever.

Questions about Psalm 133

What is Psalm 133 in Pidgin Bible?

This page contains Psalm 133 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-133/

Where can I read Psalm 133 in Nigerian Pidgin?

You can read Psalm 133 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-133/

Which Bible book contains Psalm 133?

Psalm is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Psalm 133?

The chapter identified by this reference is 133.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now