Psalm Chapter 142
Wen Wahala Dey
- I cry out to Baba-God wit my voice; I raise my voice to Baba-God as I dey ask for mercy.
2. I pour out my complain for Baba-God front, and I tell am all my palava.
3. Wen my spirit bin taya inside me, na you dey watch my way. Men don hide trap for di road wey I dey waka pass.
4. I look my right hand con see sey no pesin dey reason me! I no get where I dey hide my head, no- pesin care about my soul.
5. Oh Baba-God, I cry to you; I tok sey, “Na you I dey hide my head put, na you be my own for di land of di living.”
6. Listen to my cry, I dey low-key. Save me from di pipo wey dey show me pepper; dem too strong pass me.
7. Free me from my prison so dat I go praise your name. So good pipo go gada round me becos you dey good to me.