- Keep me safe Baba-God, na for inside your body I dey hide my head.
- I follow God yarn sey, ‘Na you be my Oga; I no get any oda good tin apart from
you.’
- As for di holy-pipo wey dey di land, na dem be glorious pipo wey I dey happy
for.
- Plenty bad tins go happun to dis pipo wey dey follow oda gods. I no go pour out
dia libations of blood or call dia name wit my lips.
- Baba-God you don give me wetin I want for life, you don secure my land and di
tins wey I get.
- My land dey for beta area.
- I go praise Baba-God wey dey advice me; even wen I dey sleep, my heart dey
tell me wetin to do.
- I dey always put God for my first. Becos he dey for my right hand, I no get
shaking.
- So my heart dey happy and my tongue dey sing; my body sef go rest wit no-lele,
- becos you no go fashi me to go grave, or you no go allow your holy pesin to
rotten.
- You don show me di way of life; you go full my heart wit joy for your front,
with jolly-jolly brekete forever—for your right hand.
Post Views: 43