Psalm Chapter 15
- Keep me safe Baba-God, na for inside your body I dey hide my head.
- I follow God yarn sey, ‘Na you be my Oga; I no get any oda good tin apart from
you.’ - As for di holy-pipo wey dey di land, na dem be glorious pipo wey I dey happy
for. - Plenty bad tins go happun to dis pipo wey dey follow oda gods. I no go pour out
dia libations of blood or call dia name wit my lips. - Baba-God you don give me wetin I want for life, you don secure my land and di
tins wey I get. - My land dey for beta area.
- I go praise Baba-God wey dey advice me; even wen I dey sleep, my heart dey
tell me wetin to do. - I dey always put God for my first. Becos he dey for my right hand, I no get
shaking. - So my heart dey happy and my tongue dey sing; my body sef go rest wit no-lele,
- becos you no go fashi me to go grave, or you no go allow your holy pesin to
rotten. - You don show me di way of life; you go full my heart wit joy for your front,
with jolly-jolly brekete forever—for your right hand.
Questions about Psalm 15
What is Psalm 15 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 15 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-15-2/
Where can I read Psalm 15 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 15 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-15-2/
Which Bible book contains Psalm 15?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 15?
The chapter identified by this reference is 15.
Topics connected to this passage
- Peace
- Guidance
- Worship