Psalm Chapter 26

Abeg share
  1. Make me dey right, Oh Baba-God, becos I don live life wey dey pure; I don trust
    Baba-God wit no shaking.
  2. Test me, Oh Baba-God, try me. Look inside my heart and mind,
  3. your love always dey for me, and I dey always waka inside you truth.
  4. I no dey sidon wit men wey dey do mago-mago. I no dey follow fake-pipo waka;
  5. I dey vex for pipo wey dey do bad. And I no fit sidon wit badbelle pipo.
  6. I wash my hand becos I dey inoccent, and I dey waka round your altar Oh Baba-
    God,
  7. dey shout your parise and tok about your wonderful handwork.
  8. I like where you dey stay, Oh Baba-God, for where your glory dey.
  9. No carry my soul comot wit sinners, or my life wit men wey like blood,
  10. wey evil plan dey dia hand, wey dia right hand full wit egunje.
  11. But my life no get errot; save me and make you sorry for me.
  12. My leg dey stand for ground wey level; for front of your plenty pikin nahin I go
    praise you Baba-god.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *