Psalm Chapter 35

Abeg share
  1. Beef those pipo wey dey beef me; fight those pipo wey dey fight me.
  2. Carry your weapon; rise up make you come epp me.
  3. Show your spear and javelin against pipo wey dey pursue me. Tell my soul, “Na
    me dey save you”
  4. Make shame plus disgrace catch those pipo wey dey dey fyne my life; make
    those pipo wey dey plan make I fall dey disappointed.
  5. Make dem be like chaff wey breeze dey blow, wit Baba-God angel wey dey
    drive dem comot go;
  6. make darkness cover dia way and make dem dror fall for ground as God angel
    dey pursue dem
  7. Since dem set dia net for me for no reason and dem don dig hole for me for
    nothing, and dem dig pit for me for no reason,
  8. make dem no even know as gbege take take fall for dia head kiakia, make di net
    wey dem set tie dem, make dem fall inside di hole con pkeme.
  9. Den my soul go happy for Baba-God and happy becos hin save me.
  10. Make all my body, spirit and soul shout, “Who be like you, Oh Baba-God? You
    don save poor men from those pipo wey get power pass dem, you don save poor
    pipo and pipo wey no get shi-shi from those pipo wey dey rob dem.”
  11. Wicked pipo dey stand up as witness against me, dem dey ask me question
    wey I no know anytin about.
  12. Dem use evil take pay back di good wey I do for dem, and dem con make my
    soul no happy at all.
  13. But di time wey dem no well, I no wear beta cloth, con cool down no chop
    becos of dem, wen my prayes no gree ansa,
  14. I dey waka about dey cry, as if I dey morn for my padi or broda. I bow my head
    wit pain for my heart as if I dey cry for my mama.
  15. But wen I fall dem gather dey happy; pipo wey dey attack me gather against
    me wen I no even know. Dem dey tok bad for my back every time.
  16. Like pipo wey no fear God, naso dem dey yab me wit badbelle, dem dey nack
    dia teeth for me.
  17. O Baba-God, how long you go dey look dey go? Save my life from dia gbege,
    save my precious life from dis lions.
  18. I go give you thanks for where your plenty pikin gather put; I go praise you for
    where pipo plenty well-well.
  19. No let those pipo wey dey beef me for no reason laff me; no let pipo wey hate
    me for no reason look me wit bad-eyes.
  20. Dem no get peace for dia mouth but dem wan lie ontop pipo head wey dey
    live jeje for di land.
  21. Dem dey open dia mouth dey look me, con say, “Aha! Aha! We don see am
    wit our own eyes”
  22. Oh Baba-God, you don see all dis tins; so make you no dey quiet. Make you no
    dey far from me Oh Baba-God.
  23. Wake up and make you rise up to defend me! Fight for me my Baba-God my
    Oga.
  24. Use your church mind take prove sey I dey right, Oh Lord my God; no let dem
    laff me.
  25. No let dem tink sey, “Aha, na wetin we want be dis!” or tok sey, “We don
    swallow am”
  26. Make shame and yawa catch all those pipo wey dey laff my palava; make
    shame catch all those pipo wey dey carry shoulder up for my side.
  27. Make those pipo wey happy sey Baba-God don tok sey I dey right—make
    shout wit joy and and happiness, make dem always tok sey, “Make Baba-God get
    levels, wey dey happy to see sey hin servant dey alright”
  28. My tongue go tok about you righteousness and your praises from morning to
    night.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *