Psalm Chapter 34
- I go lift God name up everi time; hin praises go always dey for my lips.
- My soul go make-mouth wit Baba-God; make pipo wey dey suffer hear, con dey
rejoice. - Follow me give God glory, follow me carry hin name go up.
- I fyne Baba-God and he ansa me; he make fear no catch me again.
- Those pipo wey dey look hin face dey shine; shame no go fit ever cover dia
face. - Dis poor man call and Baba-God ansa am; he save am from all hin opketu.
- Baba-God angel dey gather round those pipo wey dey fear am and he dey save
dem. - Make you taste and make you see sey Baba-God good; blessed na di man wey
dey hide hin head for Baba-God side. - Make all Baba-God holy-pipo fear am. Those pipo wey dey fear Baba-God no
dey lack anytin. - Lions sef dey taya and hungry fit catch am, but those pipo wey dey fyne Baba-
God no dey lack anytin. - Come, my pikin, listen to me; I go teach you how to fear God.
- Any of una wey love life and wey like to see many beta days.
- No use your tongue tok bad tin and make your lips no dey tok wetin no be
true. - Make una change from evil and make una do good; make una try to make
peace and make una fyne am go. - God eyes dey look righteous pipo and hin ear dey hear dem wey dem cry;
- Baba-God face dey use bad-eye look pipo wey dey do bad-bad tins, to cut dia
memory comot for dis world. - Righteous man cry out and Baba-God hear am; con save am from all hin
palava. - God dey close to pipo wey dia heart don break and he go save those pipo wey
dia spirit don weak finish. - Righeous man fit get plenty wahala but na Baba-God dey save am from all of
dem; - he go protect all hin bones, and no single one of hin bone go ever break.
- Evil nahin go kill wicked pipo; Baba-God go condemn righteous man enemies.
- Baba-God go redeem hin servant; he no go condemn any-pesin wey hide hin
head for hin side.
Questions about Psalm 34
What is Psalm 34 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 34 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-34/
Where can I read Psalm 34 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 34 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-34/
Which Bible book contains Psalm 34?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 34?
The chapter identified by this reference is 34.
Topics connected to this passage
- Love
- Salvation
- Fear
- Money