- Make your mind no dey cut becos of evil men or envy those pipo wey dey do
wrong tins,
- dem go soon dry like grass, dem go soon die like green plants.
- Trust Baba-God and make you do good; stay for di land make you enjoy safe
field.
- Happy for Baba-God mata and he go give you wetin your heart really want.
- Commit your way to Baba-God, trust am and he go do dis:
- He go make your righteousness shine like morning sun, di justice of your runs
go shine like afternoon sun.
- Make you no dey shake for where Baba-God dey and make you wait patiently
for am; No let your mind cut wen men dey succeed for dia ways, wen dem dey
plan dia bad tins.
- No dey vex anyhow and no dey pkara; no dey shake—e go only lead to evil.
- Evil men go cut comot, but those pipo wey put dia hope for Baba-God go
inherit the land.
- Now-now-now, and you go see sey the evil men no dey again; even though
you fyne dem, but you no go see dem again.
- But those pipo wey dia way na Jeje nahin go inherit di land con enjoy beta
peace.
- Wicked pipo dey plan bad tins against righteous pipo con dey nack teeth for
dem;
- but Baba-God dey laff wicked pipo, he know sey dia day dey come.
- Wicked pipo dey raise dia sword and dey bend dia bow to fall poor man and
pipo wey no get shi-shi, to kill God-pipo.
- But dia sword go shuuk dia own heart, and dia bow go break.
- Di small tin wey righteous man get beta pass di wealth of plenty wicked pipo;
- wicked man power go break finish, but Baba-God go keep righteous pipo.
- Baba-God know di days of righteous pipo and he go make dia inheritance last
forever.
- Dem no go die wen yawa gas; dem go see beta food chop wen hungry full
town.
- But wicked pipo go pkeme: Baba-God enemies go be like di beauty of field,
but dem go vanish—vanish like smoke.
- Wicked pipo dey borrow moni and dem no gree pay back, but righteous man
dey give from hin heart,
- those pipo wey Baba-God bless go inherit di land, but those pipo wey hin
curse go cut comot.
- If Baba-God like pesin way, he go make hin step dey kampke;
- even though he hit sometin, he no go fall, becos Baba-God go hold am wit hin
hand.
- I bin young but now I don old, and I neva ever see righteous man wey Baba-
God fashi or dia pikin dey beg for food.
- Dem always dey give wit free heart and dem dey borrow pipo moni wit free
mind; dia pikin go dey blessed.
- Comot your hand from evil and make you do beta tin.
- Baba-God like righteous pipo and he no go fashi hin faithful pipo. Dem go dey
protected forever, but wicked pipo pikin go cut comot;
- righteous pipo nahin go inherit di land and go stay for di land forever.
- Na wisdom dey comot from righteous man mouth, and hin tongue dey give
justice.
- Baba-God law dey for hin heart; he leg no go dror-fall.
- Wicked men dey cool down wait for righteous men, dey wait to take dia life;
- but Baba-God no go leave dem for wicked pipo hand or let dem condemn dem
if dem carry dem go court.
- Wait for Baba-God and make you keep hin way. He go make your level high to
inherit di land wen di wicked don cut comot, you go see am.
- I don see wicked man wey wicked—die, dey shine like green tree wey dey for
native soil,
- but he go soon pass away. I fyne dem taya but I no fit see dem.
- Reason pipo wey no get error, observer righteous pipo; beta future dey for
man of peace.
- But all sinners go pkeme, and di future of wicked pipo go cut comot.
- Na Baba-God dey save righteous man. Na Baba-God be hin strong-house wen
palava dey.
- Baba-God dey epp dem con deliver dem, becos dem hide dia head for hin
side.
Post Views: 35