Psalm Chapter 44

Abeg share
  1. We don hear wit awa ears, Oh Baba-God, awa palee don yarn us wetin you do
    for dia time, for olden day.
  2. You use you hand pursue di nations comot and you con put our palee for di
    land; your scata those pipo con make our papa prosper.
  3. No be wit dia sword nahin dem take win di land, and no be di weapon wey dem
    get nahin make dem win; but na your right hand, your hand, plus di light wey dey
    for your face. You love dem.
  4. Na you be my King and my God, na you tok sey Jacob must get victory.
  5. You go give us power to push awa enemies go back. Wit your name, we match
    our enemies for ground.
  6. I no dey trust my bow, no be my sword go make me win;
  7. but na you dey make us win awa enemies, you make shame catch awa
    enemies.
  8. Na Baba-God we dey use dey make-mouth from morning to night and we go
    praise your name forever.
  9. But now you don bone us and you don make us dey low level; you no dey
    escort our army again.
  10. You make us shift go back from our enemies, and our enemies don suck us
    dry.
  11. Na you let dem wan chop us like sheep and you don scata us for everi nation.
  12. You sell your pipo for chicken-change; you no gain anytin as you sell us.
  13. You don make awa neighbor dey look us like disgrace, dem dey yab and dem
    dey laff us.
  14. You don use us as example for nations, and pipo dey shake dia head for awa
    mata.
  15. Shame full my eyes everiday. Shame cover my face
  16. as those pipo wey hate me and wey no like me at all dey wyne me becos of
    my enemies wey don tok sey dem must revenge.
  17. All dis tin happun to us even though we no fashi you, or sey we no keep your
    covenant wit truth.
  18. Our heart no look back; our leg no comot for your way.
  19. But you nack us down con make jackals dey pursue us, and you con cover us
    wit deep darkness.
  20. If we bin don fashi Baba-God name, or worship foreign gods,
  21. seybe Baba-God for know, since you know di secret wey dey my heart?
  22. But becos of you, we dey face death from morning till night; dem dey reason
    us as sheep wey dem wan go kill.
  23. Wakeup Oh God! Why you dey sleep? Wake up by yourself! No fashi us
    forever.
  24. Why you dey hide your face con forget awa deep pain and oppression?
  25. Dem don bring us down to dust; our body dey rub ground.
  26. Rise up come epp us; save us becos of your love wey no dey fail

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *