- Baba-God wey mighty, di Oga, dey yarn and dey command di earth, from where
di sun dey rise from to where e dey for go down.
- Baba-God dey shine from Zion, wey get perfect beauty.
- Awa God dey come and he no go dey quiet; faya dey burn or hin front, and
serious pkara dey round am.
- He command di heaven wey dey up and di earth, so dat dem go judge hin pipo.
- “Gather me di pipo wey I don bam, wey make agreement wit me wit sacrifice.”
- And di heaven dey yarn about hin righteousness, na Baba-God hinsef be judge.
- “Make una put ears for ground, make I yarn una, chai Israel, and I go tok
against una: Na me be God, una God.
- I no dey change am for una becos of una sacrifice or una burn offerings wey
always dey for my front.
- I no need any nama or goat from una place,
- na me get everi animal wey dey inside bush and di malu wey dey untop
thousand hills.
- I know everi bird wey dey ontop di mountain, and na me get all di animal wey
dey for bush.
- If I dey hungry I no go tell you, na me get di world plus everitin wey dey inside
am.
- Abi I dey chop nama meat or dey drink goat blood?
- Sacrifice tanks offering to Baba-God, give di Most High di vow wey you
promise am
- and call me wen palava show face; I go save you and you go respect me.”
- But Baba-God dey tell wicked pipo sey, “Who give una right to dey to yarn my
laws or use una lips tok my covenant?
- You no like my teaching and una put my yarnings for una back.
- Wen una see ole, una join dem; una dey join pipo wey dey climb pesin
husband of wife.
- You dey use you mouth tok evil tins and use your tongue take play wayo.
- You dey always tok bad about your brodas, and dey bad-mouth your own
mama pikin.
- Na all dis tin you don do but I no tok anytin; you think sey I be like you. But I
go change am for you, and tok all di bad tins wey you don do for your face.
- Reason dis mata you wey don fashi Baba-God, or I go tear you put for ground
small-small and nobody to fit rescue you.
- Pesin wey sacrifice tanks offering dey honor me, and he dey prepare di way
for me to show am God wey dey save.
Post Views: 49