Psalm Chapter 50
- Baba-God wey mighty, di Oga, dey yarn and dey command di earth, from where
di sun dey rise from to where e dey for go down. - Baba-God dey shine from Zion, wey get perfect beauty.
- Awa God dey come and he no go dey quiet; faya dey burn or hin front, and
serious pkara dey round am. - He command di heaven wey dey up and di earth, so dat dem go judge hin pipo.
- “Gather me di pipo wey I don bam, wey make agreement wit me wit sacrifice.”
- And di heaven dey yarn about hin righteousness, na Baba-God hinsef be judge.
- “Make una put ears for ground, make I yarn una, chai Israel, and I go tok
against una: Na me be God, una God. - I no dey change am for una becos of una sacrifice or una burn offerings wey
always dey for my front. - I no need any nama or goat from una place,
- na me get everi animal wey dey inside bush and di malu wey dey untop
thousand hills. - I know everi bird wey dey ontop di mountain, and na me get all di animal wey
dey for bush. - If I dey hungry I no go tell you, na me get di world plus everitin wey dey inside
am. - Abi I dey chop nama meat or dey drink goat blood?
- Sacrifice tanks offering to Baba-God, give di Most High di vow wey you
promise am - and call me wen palava show face; I go save you and you go respect me.”
- But Baba-God dey tell wicked pipo sey, “Who give una right to dey to yarn my
laws or use una lips tok my covenant? - You no like my teaching and una put my yarnings for una back.
- Wen una see ole, una join dem; una dey join pipo wey dey climb pesin
husband of wife. - You dey use you mouth tok evil tins and use your tongue take play wayo.
- You dey always tok bad about your brodas, and dey bad-mouth your own
mama pikin. - Na all dis tin you don do but I no tok anytin; you think sey I be like you. But I
go change am for you, and tok all di bad tins wey you don do for your face. - Reason dis mata you wey don fashi Baba-God, or I go tear you put for ground
small-small and nobody to fit rescue you. - Pesin wey sacrifice tanks offering dey honor me, and he dey prepare di way
for me to show am God wey dey save.
Questions about Psalm 50
What is Psalm 50 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 50 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-50/
Where can I read Psalm 50 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 50 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-50/
Which Bible book contains Psalm 50?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 50?
The chapter identified by this reference is 50.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Family