Psalm Chapter 51

Abeg share
  1. Sorry for me, chai Baba-God wit your love wey no dey fail; comot my big-big
    sins wit your serious kindness.
  2. Make you wash away all my bad-bad sins and clean me from my sins.
  3. I know sey my big-big sins, and di bad tins wey always dey around me.
  4. Na against you, na only you I don sin against and I don do evil for you front, so
    dat I no fit tok for where you dey yarn, and make judgement dey correct wen you
    judge.
  5. Even sef, I be sinner wen my mama born me, I get sin from wen my malee carry
    my belle.
  6. True-true, you want make truth dey inside me, you teach me wisdom for
    inside-inside your house.
  7. Clean me wit hyssop, and I go dey clean; wash me and I go white pass snow.
  8. Make I hear Joy and gladness; make my bones wey you don press for ground
    rejoice.
  9. Carry you face comot from my sins and make you comot all my bad sins from
    my mind.
  10. Make pure heart dey inside me, Oh Baba-god, and make you give me spirit
    wey dey stand gidigbam.
  11. No purue me comot from you front or carry your holy spirit comot from my
    body.
  12. Still give me di joy wey I feel wen your save me, and give me the spirit wey go
    obey you, to fit keep me.
  13. So I go teach your way to pipo wey dey do bad-bad tins, and sinner go change
    follow you.
  14. Save me from blood of men for my head, Oh God, di God wey dey save me,
    and my my tongue go sing about your righteousness.
  15. O Lord, open my lips, and my mouth go yarn your praise.
  16. Sacrifice no dey make body sweet you, or I for bring am come; body no dey
    sweet you for burnt offering offering.
  17. Di kain sacrifice wey Baba-God want wey dey low-key; Baba-God you no go
    bone heart wey don break and heart wey ready to change.
  18. Make Zion prosper as body dey sweet you build di wall of Jerusalem.
  19. So righteous sacrifice go con dey, full burnt offering wey I go make body sweet
    you; we go offer malu for your altar.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *