- Mumu pipo don tok for dia heart sey, “Baba-God no dey.” Dem don currupt
finish and dia ways na evil; no-pesin dey do good.
- Baba-God dey look man pikin from heaven for man pikin dem to see if any-
pesin dey wey understand and wey dey fyne Baba-God.
- Everi-pesin don carry face comot, all of dem don spoil finish; pipo no dey do
beta tin. I no see one single pesin.
- Shwoo, badbelle go ever learn—pipo wey dey chop my pikin as men dey chop
bread and wey no dey call God?
- See as dem con dey, fear don kill dem finish, for where nothing bin dey
threaten dem. Baba-God don scata-scata all di bones of pipo wey dey attack you;
you make shame catch dem, Baba-God no like dem.
- Oh, make salvation for Israel come out from inside Zion. Make body sweet
Jacob and make Israel dey happy wen Baba-God go give hin pipo back dia beta-
fine-fine tins.
Post Views: 43