- Sorry for me, Oh Baba-God, men dey pursue me like fire; from morning to night
dem dey come fight me.
- Pipo wey dey mad-mouth me dey pursue me from morning to night, many of
dem they make-mouth dey come fight me.
- Wen fear dey catch me, I go trust you.
- Baba-God wey I dey praise hin word, na Baba-God I trust; fear no go catch me
again. Wetin men wey dey pkeme fit do me sef?
- from morning to night dem twist my yarnings; dem dey always plan to wound
me.
- Dem gather plan bad for my back, dem hide, dem dey look me as I dey waka, to
take my life dey hungry dem wella.
- No go let dem escape for any reason, as you dey pkara, Oh Baba-God, bring
down nations.
- Make my cry dey inside your memory, write book wit my tears—abi you don
forget dem?
- Naso my enemies go trun back wen I call for epp. Naso I go take know sey
Baba-God dey for me.
- Baba-God wey hin word I dey praise, Baba-God wey hin word I dey praise—
- Na Baba-God I dey trust fear no go catch me. Wetin men fit do me sef?
- I promise you sometin, Oh Baba-God, I go give you my thankgiving offering
come meet you.
- You don save me from death and na you make me no fall, so dat I go fit waka
for you front for di light of life.
Post Views: 56