Psalm Chapter 55

Abeg share
  1. Make you listen to my prayer, Oh Baba-God, no bone me as I dey beg;
  2. hear me make you ansa me. My mind dey wahala me and I dey pkara
  3. as I dey hear my enemies voice, as I wicked pipo dey look me; dem dey bring
    suffer-suffer for my head, dem hate me as dem dey pkara.
  4. My heart dey cry inside me; di fear of death dey pursue me.
  5. Fear dey catch me and my body dey shake; gbege don cover me down.
  6. I con sey, “Chai, I wish sey I get dove wings! I go fly go where I go fit rest—
  7. I go fly go far-far and go go stay for desert;
  8. I go rush go petch for one tree, far from di palava and kitikiti.
  9. Confuse badbelle pipo, Oh God, scata dia tongue, I see fight-fight and beef
    inside di city.
  10. Day and night, dem dey skemp upandan wit bad mind inside di city walls; hate
    and abuse full inside am.
  11. Demon wey dey scata-scata tins dey for di city; threats and lie-lie no fit comot
    from di street.
  12. If enemy dey insult me, I fit endure am, if badbelle wan change am for me, I fit
    comot for where dem dey
  13. But na you, a man like me, my padi, my pesina-pesin,
  14. wey we bin dey flex together as we dey waka wit pipo enta Baba-God house.
  15. Make my enemies die by surprise; make dem bury dem alive, evil dey stay for
    dia heart like pesin wey dey stay hotel.
  16. But I dey call you Baba-God, and God save me.
  17. Evening, morning and afternoon I dey cry taya and Baba-God hear my voice.
  18. He save me from me without wound from di fight wey pipo dey fight me, even
    though plenty pipo dey againt me.
  19. Baba-God wey dey for throne forever, he go hear dem con put kasala for dia
    head, men wey no fit change and wey no dey fear Baba-God.
  20. My padi dey attack hin pesina-pesin; he don break di promise wey hin make.
  21. Hin yarnings smooth like butter but na war full hin mind; he yarning sweet like
    ororo, but na fight he wan fight.
  22. Give Baba-God all your wahala and he go make you maintain; he no go ever
    let righteous pipo fall.
  23. But you Oh Baba-God, you go bring down di wicked man inside wuru-wuru pit;
    men wey like blood and wey dey do mago-mago no go live half of their life. But as
    for me, I go trust you.

Questions about Psalm 55

What is Psalm 55 in Pidgin Bible?

This page contains Psalm 55 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-55/

Where can I read Psalm 55 in Nigerian Pidgin?

You can read Psalm 55 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-55/

Which Bible book contains Psalm 55?

Psalm is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Psalm 55?

The chapter identified by this reference is 55.

Topics connected to this passage

  • Faith
  • Prayer
  • Salvation
  • Peace
  • Fear

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now