- Oh Baba-God, praise dey wait for you, for Zion; na you we go give the tins wey
we promise you.
- Oh you wey dey hear prayer, all men go come meet you.
- You forgive di bad-bad tins wey we dey do wen sins cover us finish.
- Blessed na those pipo wey you don choose, wey you don near— to live inside
your house! We don belleful wit di beta tins wey dey inside your house, wey dey
for your holy temple.
- You dey ansa us wit ogbonge works of righteousness, Oh Baba-God wey dey
save us, na you be di hope of ends of di earth and even di seas wey dey far-far,
- na you form di mountains wit your power and you give yourself strength like
weapon,
- na you tell water wey dey vex sey make e cool down, di wave wey dey pkara
and di kitikiti wey dey di nations.
- Those pipo wey dey stay far-far dey fear your wonders; where day dey break
and evenng dey fade, you dey bring songs wey dey make belle sweet pesin.
- You dey take care of di land and you dey water am; you make di land good well-
well. Water full inside Baba-God stream to give hin pipo food, naso you don do
am.
- You comot water from inside di channel, con level di ridges, you use rain make
am soft and you bless di crops.
- You crown di year wit beta harvest and your basket don full throway.
- Di grasslands of di desert dey pour-throway; happiness nahin cover di hills.
- Animals burku for field and na food brekete for di valley; dem shout wit joy
con sing.
Post Views: 25