Psalm Chapter 64
- Hear me, Oh Baba-God, as I dey voice my complain; protect my life from enemy
threat. - Hide me from di bad coded tin wey wicked don plan for me, from noise of di
plenty evil pipo. - Dem dey sharp dia tongue like sword and dem dey throw yarning like sharp
arrow. - Before innocent man know dem don shoot; dem no even fear, dem just shoot
am like dat. - Dem they support dia sef for dia bad plan, dem dey tok as dem go take hide dia
trap; dem sey, “Who go dem?” - Dem plan ojoro dem con sey, “We don get beta plan!” True-true, man mind
and heart too get wayo. - But Baba-God go shoot dem like arrorws; now-now-now Baba-God go nack
dem down. - He go use dia mouth put dem for wahala con scata dem finish; everi-pesin wey
see dem go laff shake head. - Fear go catch everi man, dem go tok about Baba-God handwork con eaon wetin
hin don do. - Make the righteous pipo happy for Baba-God, and make dem hide dia head
for Baba-God body; make everi-pesin wey get clean mind praise am!
Questions about Psalm 64
What is Psalm 64 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 64 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-64/
Where can I read Psalm 64 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 64 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-64/
Which Bible book contains Psalm 64?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 64?
The chapter identified by this reference is 64.
Topics connected to this passage
- Fear
- Worship