- O Lord my God, na for your side I dey hide my head put; save and deliver me
from those pipo wey dey pursue me,
- or dem go tear my body like lion con cut my body like meat and nobody go fit
save me.
- Oh Lord my God, if I don do dis and my hand no clean—
- if I do bad tin to pesin wey no find my trouble or go rob my enemy for no
reason—
- So make my enemy pursue me con catch me; make dem match my life for
ground con make me sleep for dust.
- Standup God-Baba as you dey pkara. Standup make you change am for my
enemies as dem dey pkara. Wakeup my God; declear your justice.
- Make di pipo wey gather—make dem round you. Rule dem from above;
- Make Baba-God judge di pipo. Judge Oh God, based-on my good name, Oh
most high.
- Oh righteous God wey dey see everi-pesin mind and heart, stop di violence of
wicked pipo and protect your pikin.
- My guard na Baba-God most High wey dey pipo wey get clean heart.
- Baba-God na righteous judge, God wey dey pkara everiday.
- He no slack, he go sharp hin sword, con set hin bow.
- He don arrange hin bad-bad weapons; he don set hin arrow wey get faya.
- Pesin wey carry badbelle like woman wey get belle go born disappointment.
- Pesin wey dig pit con dey pack di sand come outside go fall inside the pit wey
he dig.
- Di wahala wey he start go tie am like rope; he go use hin head carry di
violence.
- I go thank Baba-God becos he dey righteous and I go sing praise to hin name
of di Lord most High.
Post Views: 51