Psalm Chapter 6
- Oh Lord, no yari for me wen you dey vex or correct me wen you dey pkara.
- Lord sorry for me, my bone no strong; I be like paper.
- My soul dey vex no be small. How long O Lord, how long?
- Look my side chai Baba-God and make you deliver me; save my life becos your
love no dey fail. - No pesin go remember you wen hin don die. Who fit throway-salute for you
from grave? - I don taya to dey cry inside; throught di night I dey cry river ontop my bed and
soak my chair wit water from my eyes. - My eyes dey pain me becos of too much cry-cry; dem dey pain me becos of my
enemies. - Comot for my side badbelle dem, Baba-God don see hear my cry.
- Bab-God don hear my cry for mercy; God don hear my prayers.
- Shame go catch all my enemies and dem go dey disappointed; dem go turn
back and shame go catch dem kia-kia.
Questions about Psalm 6
What is Psalm 6 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 6 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-6/
Where can I read Psalm 6 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 6 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-6/
Which Bible book contains Psalm 6?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 6?
The chapter identified by this reference is 6.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Strength