- Chai Baba-God, pkapkapka, make you save me; Oh Baba-God kiakia come epp
me.
- Make shame and confusion catch those pipo wey wan kill me; make all those
pipo wey want make I fall turn back wit disgrace.
- Make those pipo wey tell me sey, “Aha! Aha!” make dem turn back becos
shame don catch dem.
- But make all those pipo wey dey fyne you rejoice and happy wit you; make
those pipo wey love your salvation always tok sey, “Make Baba-God level high!”
- But I dey poor and no get shi-shi; sharp-sharp come meet me, Oh Baba-God. Na
you be my epp and na you dey free me; Oh Lord, make you no waste time.
Post Views: 40