Psalm Chapter 70

Abeg share
  1. Chai Baba-God, pkapkapka, make you save me; Oh Baba-God kiakia come epp
    me.
  2. Make shame and confusion catch those pipo wey wan kill me; make all those
    pipo wey want make I fall turn back wit disgrace.
  3. Make those pipo wey tell me sey, “Aha! Aha!” make dem turn back becos
    shame don catch dem.
  4. But make all those pipo wey dey fyne you rejoice and happy wit you; make
    those pipo wey love your salvation always tok sey, “Make Baba-God level high!”
  5. But I dey poor and no get shi-shi; sharp-sharp come meet me, Oh Baba-God. Na
    you be my epp and na you dey free me; Oh Lord, make you no waste time.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now