Psalm Chapter 74
Baba-God Abeg
- Dis na Maskil of Asaph. Oh Baba-God, why you don fashi us forever? Why you dey
use vex dey rise like smoke—against di pipo of your green-land? - Remember di pipo wey you buy tey-tey, di tribe wey belong to you, wey you save—remember Mount Zion wey you don stay.
- Carry your leg face di scata- scata wey no dey finish. Di enemy don scata everitin
inside your holy-place. - Your enemies dey shout for where your pipo dey gada; dem set dia flag as sign.
- Dem be like men wey dey carry axe to cut big trees.
- Your enemies use dia axe plus hammer—take scata all di artwork wey dey carved.
- Dem burn your holy-place reach ground; dem spoil your place of worship.
- For dia heart dem tok sey, “Make we scata dem kpatakpata!” Dem don burn everi where wey pipo dey worship Baba-God for di land.
- We no see any miracle signs, no prophet dey again, and no-pesin know how long all
dis tins go last. - Oh Baba-God, how long di enemy go dey yab you? Shwoo….your enemies go dey
insult your name forever? - Why you dey drag your hand go back, even your right hand? Stretch your hand come out—make you scata dem!
- Oh Baba-God, na you be my King since olden days. You don bring salvation come di earth.
- Na you divide di big-river wit your pawa; you break di head of di dragon for inside water.
- Na you break di head of di dragon to pieces, and you con give am as food to di
desert nations. - Na you open springs and streams; you make big river dry.
- Na you get di day, na you sef get di night; na you make di sun plus moon.
- Na you make all di borders of dis earth. Na you make cold- season plus hot-season.
- No forget how di enemies don yab you, chai Baba-God, and how mumu pipo bad mouth your name.
- No give di life of your dove to wild animals; no forget di lives of those pipo wey dey suffer forever.
- Keep your agreement wey you make wit us, becos wickedness burku for everi dark
corner for di land. - No let pipo wey dem dey oppress use disgrace run go back; make poor pipo plus
pipo wey need epp—praise your name. - Rise up Oh Baba-God make you defend your way; remember as mumu pipo dey yab you everi day.
- No forget as your enemies dey raise dia voice—di katakata of those pipo wey dey rise
against you dey burku more-more.