- True-true Baba-God dey good to Israel, to those wey dia heart pure.
- But as for me, my leg almost dror-fall; my leg almost comot for ground.
- I con dey jealous pipo wey dey make mouth wen I see as badbelle dey blow.
- Dem no get wahala; see as dia body dey health, con strong.
- Dem no get the kain palava wey pipo get; dem never jam opketu.
- Dat na why to dey make-mouth be like dia necklace; dem tie fight-fight for
body like wrapper.
- Dem dey do bad-bad tins from dia heart wey no-send any-pesin, di bad tins wey
dem dey plan for dia mind no fit finish.
- Na yab and hatred full dia mouth; dem dey make-mouth sey dem go oppress
pesin.
- Dem dey claim heaven and dia tongue dey claim di earth.
- So dia pipo dey turn go meet dem to drink plenty water.
- Dem sey, “How Baba-God go take know? Abi Baba-God know anytin?”
- Naso wicked pipo be—dem no-send, dem dey make more moni.
- I just dey waste time dey keep my heart pure; I just dey waste time dey form
innocenti.
- Suffer full my head from morning to night. Na everi morning dem dey
purnishment me.
- If to sey I sey, “Naso I for yarn,” I for sell awa una pikin dem.
- Wen I con try understand everi-everi, the tin dey oppressive to me
- untill wen I con enta inside Baba-God holy-place; I con understanddi destiny of
badbelle pipo.
- True-true, you don put dem for place wey dem go dror-fall; you scata-scata
dem for ground finish.
- See as dem don scata finish now-now-now. Serious gobe don sweep dem
comot.
- As dream be wen pesin don wake, naso e go be wen you raise up, Oh Baba-
God, you go fashi dem like wetin no dey exist.
- Wen my heart dey cry and my spirit dey vex,
- I no get sense and I be olodo; I be like wild nama for your front.
- Upon dat, I still always dey wit you, you hold me for my right hand.
- You guide me wit your advice and las-las you go give me levels.
- Who I get for heaven except you? Nothng dey for dis earth wey I want except
you.
- My body and my heart fit fail, but na Baba-God be di strength wey dey my
heart and nahin be my own forever.
- Those pipo wey dey far from you go pkeme; you scata those wey no get your
time.
- But as for me, e dey good to carry body near Baba-God.
- God wey nobody dey control nahin I dey hide my head put. I go tok about all
your handwork.
Post Views: 19