Psalm Chapter 76
Baba-God Of Victory Plus Judgement
- To di main producer of music. On instrument wey get one string. Dis na Psalm—Song of Asaph. Dem know Baba-God for Judah; and hin name great for Israel.
- Na inside Salem Baba-God worship-place dey, hin house dey for Zion.
- Na for there he break di arrows and bows, di shield plus di sword, and di weapons for
war. - You get levels and you fine pass mountain wey bush meat plenty put.
- Dem obtain strong men, dem sleep dia last sleep; none of di warriors fit raise dia hand
go up. - Oh Baba-God of Jacob, wen you use vex tok—both horse and horse-moto kpeme.
- Na only you pipo suppose dey fear. Who fit stand for your front wen you dey vex?
- From heaven—you give your judgement, and di earth fear, con dey silent,
- oh Baba-God, wen you stand up to judge—to save all di pipo wey dem dey oppress for di land.
- True-true, men dey give you more levels wen dem change-am-for you, and you go deck-up wit di remaining vex.
- Make promise to Baba-God, and do wetin you promise; make all di pipo wey dey round am—carry gifts con meet Baba-God wey dem suppose dey fear.
- He go cut di spirit of rulers komot, and di kings of di earth dey fear am.