Psalm Chapter 77

Abeg share

Na Baba-God Dey Cool Pesin Down

  1. To di Chief producer. To Jeduthun. Dis na Psalm of Asaph. I cry to Baba-God wit my voice. I cry to Baba-God wit my voice—and he hear me.
  2. I fyne Baba-God, wen I dey inside wahala; tru-out di night I stretch my hand to pray, and I no taya. My soul no gree cool down.
  3. I remember Baba-God, and I cry; I complain, and my spirit con dey weak.
  4. You no let my eyes close; my wahala burku—sote I no-fit tok.
  5. I con reason olden days, and di life of before-before;
  6. I remember my song for night, I meditate for my heart, and my spirit dey fyne you
    seriously:
  7. “Shwoo..Abi Baba-God wan fashi me forever? Abi he go fit show us hin favour
    again?
  8. Abi he don stop to sorry-for pesin forever? Abi hin promises don fail forever?
  9. Abi Baba-God don forget to show us hin grace? Abi he don use vex stop to sorry-for us
    wit jeje?”
  10. I con tok sey, “Dis na my wahala; but I go remember di year of di right hand of di Oga
    kpatakpata.”
  11. I go remember wetin Baba-God don do; Yes, I go remember di miracles wey you don do tey-tey.
  12. I go meditate on all your works sef, con tok about your works.
  13. Oh Baba-God, your ways dey holy, which god great like awa God?
  14. Na you be di God wey dey perform miracle; you show your pawa among di pipo.
  15. You don use your big hand take save your pipo, di sons of Jacob plus Joseph.
  16. Oh Baba-God, di Red sea see you, di water see you—con dey fear; di big-river
    wey deep con dey shake.
  17. Rain pour from di clouds, di heavens sound wit thunder; your arrow of lightning
    dey flash.
  18. Dem hear your thunder inside di rolling breeze, your lightning light up di world. Fear
    catch di earth, and di earth con dey shake.
  19. Your road pass tru di big-river, your ways pass tru big-big water, and no-pesin sabi your steps.
  20. You use Moses and Aaron hands take lead your pipo as shepherd take dey lead sheep.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *