Psalm Chapter 84
Baba-God House Dey Hungry Me
- For di producer of music. Play am to di music instrument of Gath. See as your house fine well-well, Oh Baba-God Almighty!
- My soul dey hungry, eehn…e dey faint just to enta Baba-God house; my heart plus
my body dey cry out for di living God. - Even di birds don see house—she don see bird-house for hersef—where she go fit lay
her eggs put; even near your altars, oh Baba-God Almighty, my Igwe and my God. - Blessings for those pipo wey dey stay for your house; dem dey always praise you.
- Blessings for di man wey depend on Baba-God for pawa, wey dia heart dey on di
road to Zion. - As dem dey pass bottom of di mountain wey dem dey call Baca, dem turn am to
spring; and rain sef dey cover am wit pools. - Dem get pawa more-more as dem dey move—until everi single one of dem show
face for Baba-God front for Zion. - Hear my prayer, Oh Baba-God Almighty; hearme, Oh Godof Jacob.
- Oh Baba-God, look awa shield; and shine your face on di pesin wey You anoint. you?
- E beta make I dey one day for your house, dan make I spend one thousand days
for anoda place. E beta make I be gateman for your house, dan make I dey for wicked man house. - Baba-God na sun and defense; Baba-God dey give grace plus levels; he no go hide any beta tin from pipo wey get clean hand.
- Oh Baba-God Almighty, blessings for di man wey trust you!