Psalm Chapter 85
Call Upon Baba-God To Sorry-for Us
- For di producer of music. Dis na Psalm of di son of Korah. Oh Baba-God, you don favour your land; you don bring back di prisoners of Jacob.
- You don forgive di wrong tins wey your pipo do, con cover all dia sins.
- You don stop to dey vex for dem, you don turn from your serious vex.
- Oh Baba-God save us again, and stop to dey vex for us.
- Abi you wan vex for us forever? Abi you wan vex for us for all di generations?
- Abi you no go ginger us again, so dat your pipo go happy becos of you?
- Sorry-for us, oh Baba-God, and give us your salvation.
- I go listen to wetin Baba-God di Oga go tok; he go promise peace to hin pipo, plus hin holy-pipo—but make dem no do mumu tins again.
- True-true, hin salvation dey near pipo wey dey fear am, so dat hin glory go dey for di
land. - Mercy plus truth don jam togeda, goodness plus peace don kiss each oda.
- Truth go show-face from di earth, and goodness go look down from heaven.
- Baba-God go true-true give una beta tins, and awa land go produce e harvest.
- Goodness go dey for Hin front, and e go make Hin steps—awa way
Questions about Psalm 85
What is Psalm 85 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 85 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-85/
Where can I read Psalm 85 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 85 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-85/
Which Bible book contains Psalm 85?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 85?
The chapter identified by this reference is 85.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Forgiveness
- Peace
- Fear
- Guidance