Psalm Chapter 88
Dis Na Prayer For Freedom From Death
- Dis na Song. Na Psalm of di son of Korah. To di music producer. Based-on “Di suffer head of palava.” Dis na Maskil of Heman di Ezrahite. Oh Baba-God, na you be di God wey dey save me, day and night nahin I dey cry for your front.
- Make my prayer reach your front, bend your ear to hear my cry.
- Wahala full my soul, and e be like sey I wan kpeme.
- Dem don count me among pipo wey dem go bury; I be like pesin wey no get any pawa.
- Dem leave me wit deadbody, like pipo wey don die inside grave—wey you no remember
again, and wey don cut komot from your hand. - You don put me inside deepest pit, inside darkness, inside di deep- deep side.
- Your vex dey press me down wella, you don suffer me wit all
- You don pursue my padi far komot from my side, and you don make me be like yama-yama for dia eyes. I dey locked up, no way for me to komot;
- my eye dey close becos of cry- cry. Oh Baba-God, I don call you everi day. I don carry my hand give you.
- Abi you fit show your wonders to deadbody? Abi those pipo wey don die go
raise up to praise you? - Abi na for grave dem go tok about your soft-love, or tok about your faithfulness where everitin don dabaru?
- Abi dem fit see your wonders for where light no dey, or your good ways for di land of di dead?
- But oh Baba-God, I don cry out to you; for morning my prayer dey come meet you.
- Oh Baba-God, why you dey fashi my soul—why you dey hide your face from me?
- l don dey suffer since wen I small—like sey I wan kpeme. I dey suffer from your wahala, and palava cover me.
- Your serious vex don cover me, your kasala don cut me komot.
- Dem surround me everi day like water—dem cover me for everi angle.
- You don carry my padi and pipo wey I love—komot from my s