- I go salute you, O God wit all my heart; I go tok about your ogbonge work.
- I go dey glad and rejoice in you; I go sing praises to your name O Jah Most High.
- My enemies turn back; and dem kick sometin, con pkeme for your front.
- Na you epp me fight for my right and my runs; you don sidon for your throne,
and you dey judgment dey correct.
- You don flog di nations con dabaru wicked pipo; you don comot dia name
throway for inside for ever and ever.
- Suffer wey no dey end don catch di enemy; you don comot dia cities from
ground; nobody go remember dem again for this life.
- Baba-God dey reign forever; he don put hin throne gidigbam for judgement.
- He go judge di world based-on on righteousness; he do rule di pipo wit justice.
- Na Baba-God body pipo wey dem dey oppress dey hide dia head put, Baba-God
na stronghold wen wahala dey.
- Those pipo wey know your name go trust in you, you no dey ever fashi pipo
wey trust you.
- Make you sing praises to Baba-God wey sidon for him throne for Zion; tell di
nations wetin he don do.
- Any-pesin wey wan revene for blood always dey remember; Baba-God no dey
bone di cry of pesin wey dey go tru serious pain.
- Oh Lord, see as my enemies dey show me pepper! Sorry for me make you
carry me comot from di gate of death,
- so dat I go fit tok about your praise for front of di daughters of Zion and na for
there I go happy sey you save me.
- Di nations don fall inside di hole wey dem dig; di net wey dem code don hook
dia leg.
- Everi-pesin know Baba-God becos he dey judge wit hin church-mind; wicked
pipo dey enta trap wit dia handwork.
- Wicked pipo dey go six feet straight, all di nations wey fashi Baba-God.
- But Baba-God go remember poor man, di hope of di soul wey dey pass tru
yawa no go pekeme.
- Standup O Lord, make man no win you; make you judge di nations for you
front.
- Nack dem wit gbege, Oh Lord, make di nations know sey dem no fit reach
Baba-God.
Post Views: 67