Psalm Chapter 9
- I go salute you, O God wit all my heart; I go tok about your ogbonge work.
- I go dey glad and rejoice in you; I go sing praises to your name O Jah Most High.
- My enemies turn back; and dem kick sometin, con pkeme for your front.
- Na you epp me fight for my right and my runs; you don sidon for your throne,
and you dey judgment dey correct. - You don flog di nations con dabaru wicked pipo; you don comot dia name
throway for inside for ever and ever. - Suffer wey no dey end don catch di enemy; you don comot dia cities from
ground; nobody go remember dem again for this life. - Baba-God dey reign forever; he don put hin throne gidigbam for judgement.
- He go judge di world based-on on righteousness; he do rule di pipo wit justice.
- Na Baba-God body pipo wey dem dey oppress dey hide dia head put, Baba-God
na stronghold wen wahala dey. - Those pipo wey know your name go trust in you, you no dey ever fashi pipo
wey trust you. - Make you sing praises to Baba-God wey sidon for him throne for Zion; tell di
nations wetin he don do. - Any-pesin wey wan revene for blood always dey remember; Baba-God no dey
bone di cry of pesin wey dey go tru serious pain. - Oh Lord, see as my enemies dey show me pepper! Sorry for me make you
carry me comot from di gate of death, - so dat I go fit tok about your praise for front of di daughters of Zion and na for
there I go happy sey you save me. - Di nations don fall inside di hole wey dem dig; di net wey dem code don hook
dia leg. - Everi-pesin know Baba-God becos he dey judge wit hin church-mind; wicked
pipo dey enta trap wit dia handwork. - Wicked pipo dey go six feet straight, all di nations wey fashi Baba-God.
- But Baba-God go remember poor man, di hope of di soul wey dey pass tru
yawa no go pekeme. - Standup O Lord, make man no win you; make you judge di nations for you
front. - Nack dem wit gbege, Oh Lord, make di nations know sey dem no fit reach
Baba-God.
Questions about Psalm 9
What is Psalm 9 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 9 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-9/
Where can I read Psalm 9 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 9 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-9/
Which Bible book contains Psalm 9?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 9?
The chapter identified by this reference is 9.
Topics connected to this passage
- Faith
- Hope
- Salvation
- Money
- Worship