- Sing new song for Baba-God; sing for God, all di whole earth.
- Sing for Baba-God, praise hin name; tok about hin salvation day by day.
- Tok about hin glory for front of di nations, con yarn about hin ogbonge works
among all hin pipo.
- Baba-God na ogbonge and he get levels to receive awa praise; dem suppose
fear am pass all di oda gods.
- All di gods of di nations na idols, but na Baba-God make di heavens.
- Beauty and majesty dey for hin hand. Strength and glory dey hin holy-place.
- Make all the families of di nations tok sey na Baba-God get glory and strength.
- Give Baba-God di glory wey fit hin name; bring offering come hin caban.
- Worship Baba-God inside di beauty of hin holiness; make all di earth shake for
hin front.
- Tok among of di nations sey, “Baba-God dey on board.” Di world stand
gidigbam, e no fit move; he go judge di pipo wit hin church-mind.
- Make di heavens rejoice, and make di earth jolly; make di seas make noise
plus everitin wey dey iniside am;
- make di field jubilate and everitin wey dey inside. Naso all di trees wey dey
inside di forest go sing wit joy;
- dem go sing for Baba-God front, becos he dey come, he dey come judge di
earth.
- He go judge di world wit clean-heart and judge di pipo wit truth.
Post Views: 40