Psalm Chapter 97

Abeg share
  1. Di Lord dey reign, make di earth dey happy; make di water wey dey far-far dey
    rejoice.
  2. Cloud plus heavy darkness dey around am; righteousness plus justice na di
    foundation of hin throne.
  3. Faya dey burn for hin front wey dey lick hin enemies wey dey all hin side.
  4. Na hin lightening dey light up di world; di earth see am con fear-fear.
  5. Di mountains dey melt like candle water for Baba-God front, for front of di Oga
    pkata-pkata of all di earth.
  6. Di heavens dey yarn about hin righeousness and all di pipo dey see hin levels.
  7. Shame don dey catch all di pipo wey dey worship image—those wey dey make-
    mouth wit dia idols—make una worship am all di gods!
  8. Zion hear dey rejoice plus di villages wey dey Judah dey happy becos of your
    judgement, Oh Baba-God.
  9. Na you, Oh Baba-God, be di Most High for di whole earth; you get levels pass all
    di gods.
  10. Make all those pipo wey love Baba-God hate evil, he dey guard di lives of hin
    faithful pikin, con comot dem from wicked pipo hand.
  11. Light dey shine for righteous pipo head and joy dey for di head of pipo wey get
    clean heart.
  12. Rejoice for Baba-God, all of una wey dey righteous and praise hin holy name.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now